Featured

My First Blog Post

Be yourself; Everyone else is already taken.

— Oscar Wilde.

Okay back to the matter wey dey ground, tru tru, na my first blog post be this na why i wan share something wey go blow una mind. Hmmmm this thing wey i wan share with you don dey bother me tey tey but i no know as i go take talk am. My ex girlfriend na pesin wey una sabi well well her name na Nicki Minaj, i know say una no go believe me but mafo, we dated and i no go ever forget wetin she do me (sobbing).

3 years ago when i bin chop 50k for bet9ja, i wan craze enter gutter because 50k to me that year be like 50 million, but i no get sense. When i withdraw the money, na my friend ChukwuEmeka tell me about one club wey dem just open for hin side and say babes go dey there plenty. Naso i run enter boutique say i go dress to oppress anybody for the club today, na im i see the cloth wey Timaya talk say im buy for sososo pounds, my eyes enter am i ask for the price, the omo ibo tell me say na 5k but as say na me make i pay 3k, make we no long matter na 2k i pay for the cloth.

Fastforward to club…

Naso i sight the thing from the VIP corner wey i bin dey, i swear the thing big pass Mercy big brother own, na im Ebuka pinch me say make i no try am say na Senators dey run am, i no even mind Ebuka, na the Barka i still dey look, naso i stand up gather all the courage and the 20k wey remain from the 50k go meet the girl for where she siddon, we talk talk talk talk, i buy am drink and pepper-soup. For my mind i don win her heart with the things wey i dey buy for am, i no know when i spend 17k on top am for the club. After she don almost chop and drink finish, naso one man come from no where, he and the girl hug, the man ask who i be naso the girl answer talk say “Babe he’s a total stranger but he’s the one who kept me company before arrived” Omo i shock as i hear am, i no fit laugh and i no fit cry my face just blank i no fit talk sef. The man come tell me thank you say make i come dey go, naso i change am for am say this Nicki Minaj wey siddon for here na my babe and say i don spend thousands of naira on top am say nothing fit carry me comot for this club. The man just whistle two times, na im 2 bouncers come carry me, beat hell comot for my body. The 3k wey remain sef na hospital i spend am finish. After then i never chop reach 5k since i dey play bet9ja, na why i come open blog say i no go play bet9ja again and make boredom no kill me put for house.

Here brings us to the end of my first blog post, I’m just getting this new blog going, so stay tuned for more. Subscribe below to get notified when I post new updates.

Design a site like this with WordPress.com
Get started